See ehn, as Nigerians living in Nigeria (yes, not the ones wey dey Canada dey sip hot chocolate while shouting “E choke!” on IG), we sabi the hustle.
We dey live am real-time.
Na we dey enter traffic by 5am with eyes still closed, na we dey price tomato like say na real estate, na we dey shout “No fuel!” every other week like it’s a national anthem.
We no dey pretend here, the struggle is premium.
The country hard pass granite. And let’s not even start with our dear leaders, whose favorite Olympic sport is “How to Mismanage Funds in 10 Easy Steps.”
Their greed, corruption, and complete disregard for the common man has turned everyday survival into a full-blown spiritual warfare.
But you see this wahala?
This heat?
This constant gbas gbos of life?
It’s turning all of us into walking time bombs.
We’re angry, and understandably so, but too many of us are misplacing that anger.
Instead of facing the real architects of our problems, we dey face each other like say na fellow hustlers wey dey inside same Titanic cause the iceberg.
Customer go vex for POS girl wey charge ₦300.
Driver go insult passenger because ₦100 change no complete.
Tailor go collect cloth and forget your existence for three months.
Why?
Because everybody dey boil. But my people, na who go calm am down if everybody dey boil?
Let me say this with all due respect and a sprinkle of jollof wisdom
Channel that vex into your hustle, not your neighbor.
Turn that anger into innovation.
Let your frustration push you to work smarter, build something, move ahead. Because truth be told, we’re all co-authors in this drama, just like we were all involved in the crucifixion of Christ (no argue, just flow with me 😅), we are all caught in the crossfire of this national madness.
But we don’t have to deepen the wounds.
You think you’re the only one going through it?
No o. We plenty for here!
You see that guy you just insulted on the queue? Him never chop today.
That woman you just shouted at in the bank? She dey find money for her pikin school fees.
Life don already serve everybody pepper and breakfast, no add your own atarodo on top.
So I beg, no use another man’s head build your own ladder to survival.
Let love lead.
Be kind, even when it’s hard.
Because at the end of the day, na only we dey here with ourselves.
The leaders no dey feel this heat, them dey AC 24/7 dey post “work visit” with captions longer than fuel queues.
Abeg, shine your hustle, protect your peace, and let’s try small to carry each other along.
This life na pot of beans, but together we fit add small seasoning.